By : Jolayemi Olajide
Popular Naija comedian, Bovi Ugboma, don open mouth yarn for sit down tuk say he dey happy when pipo divorce if di marriage don change to suffer-suffer.
Bovi yarn inside the show say marriage no suppose be do-or-die marra and he go celebrate divorce because e mean say di couples fit breathe well now.
Dis marra trend as Bovi change narrative on top how pipo dey see divorce for Nigeria, yarn say to comot for bad union clean pass to stay inside wahala.