National

Court Don Reject Case Wey Dem File Against Tinubu Over Emergency Rule For Rivers.

todayOctober 2, 2025 4

Background
share close

Justice James Omotosho wey dey Federal High Court for Abuja don throway one case wey challenge emergency rule for Rivers State. Na Belema Briggs and four other people carry di case go court, say dem wan challenge di emergency rule wey President Bola Tinubu declare. But Justice Omotosho talk say dem no get legal right to carry such case come court. Di judge still talk say na only Supreme Court fit settle that kind matter.  E also talk say none of di people wey carry di case talk say dem be member of di State Executive Committee, House of Assembly, or say di emergency don wound dem personally. Di court still talk say none of di people wey carry di case get approval from di Attorney General to start di matter. Justice Omotosho talk say wetin di President claim say di emergency stop law and order from scattering nobody argue am. Di judge still add say di talk about human rights violation no hold water because di President use correct Emergency Rule Order take act.

Di court talk say di case no get head or tail say e dey frivolous and no get base at all. Dem still point out say di people wey carry di case no get consent from Rivers people before dem file am. President Tinubu declare state of emergency for Rivers State for March. E suspend Governor Fubara, him deputy, plus all di State Assembly members. Di President put retired Vice Admiral Ibokette Ibas as Administrator to manage di state. Tinubu talk say di emergency na because political palava dey rise and oil infrastructure dey get attack. Federal government fear say if nothing happen, law, order, and economy fit scatter. Di emergency na to bring back security and stop more wahala for di state. Tinubu call off di emergency on September 17, say politics don cool down and stability don return. Governor Fubara, im deputy, and di Assembly members start work again di next day as supporters happy welcome dem. People for di state protest during di emergency, dey ask make democracy return.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app