National

Court Luck 5 Police Officers For Prison For Di Ogidi Killing Inside Effuren

todayJune 3, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Delta State High Court for Asaba don order make dem lock di ASP Usman Nuhu, and im four gang member for Ogwashi-Uku Correctional Centre.

Dis officers dey face case say dem do extrajudicial killing of 28-year-old Oghenemene Ogidi, wey people know as OG Millan, for Effurun, Delta State.

Di incident happen on April 26, 2026, and e cause serious public outrage afta video of di shooting circulate online.

Court order say make dem remain in custody for 15 working days while dem dey wait legal advice from di Delta State Attorney-General, and say future court proceedings go dey held virtually.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds