By: Rilwan Agbomeji
Federal High Court for Abuja don order make government hold 57 properties wey dem say get link with former Attorney-General, Abubakar Malami, and two of im pikin dem, Abdulaziz and Abiru-Rahman.
Justice Emeka Nwite give di order afta EFCC carry ex parte application come court on Tuesday.
EFCC talk say di properties, wey value reach about N213.2 billion, be money from illegal activities.
Dem say di properties dey Abuja, Kebbi, Kano and Kaduna, and e include hotels, schools, filling stations, estates and plenty land.