By: Esther Ayoola
National Industrial Court for Abuja don fix today (Tuesday) to give ruling for one case wey FCT Minister, Nyesom Wike, and FCT Administration carry go court against leaders of Joint Union Action Committee (JUAC).
Justice E.D. Subilim hear argument from both sides before e adjourn di mata for last sitting.
Wike and FCTA dey ask court, make e stop JUAC Chairman Rifkatu Iortyer and Secretary Abdullahi Umar from any strike, picketing or lockout.
Di strike wey start last Monday don scatter work for plenty FCTA offices for Abuja, including di secretariat, as security men block pipo from entering.