Lagos

Customs Seize 3,398 Cartons Of Codeine Syrup Worth N3.39bn For Apapa Port

todayMarch 17, 2026 4

Background
share close

Di Nigeria Customs Service Apapa Command say, dem don seize 3,398 cartons of codeine syrup wey smugglers hide inside household utensils for Apapa Port, Lagos, worth about N3.39 billion.

According to di command tuk, tuk, Isa Sulaiman, di interception hapun on Sunday, after customs officers carry out quick follow-up operation.

Sulaiman quote di Customs Area Controller, Emmanuel Oshoba, say di operation na success through joint work with di National Drug Law Enforcement Agency.

Oshoba say di seizure show di command strong commitment to stop illegal drugs from entering di country.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app