By : Jolayemi Olajide
Afrobeats superstar Davido don carry Naija security mata enter global level, as im use di FIFA World Cup countdown concert to tell Nigeria gorment to go an rescue the students and teachers wey bandits pack for Oriire LGA, Oyo State.
OBO rock one bad black leather jacket wey full with green buttons, and every single button carry the name of the victims to show di world say pipo dey cry for Nigeria.
To code di tragic level well, the names of the pipo wey dey inside bush, im write am with white, while the names of the innocent souls wey the bandits don kpai dey bleed in red ink.
The music star still print “NIGERIA” full front for em white tee, come stamp “BRING THEM HOME” with bold letters for the back of the jacket to base words give authorities make dem rescue the victims sharp-sharp.