By: Rilwan Agbomeji
One Former presidential candidate and Atiku Abubakar close friend, Dele Momodu, don clear marra, say Atiku no go withdraw from 2027 presidential race to support Peter Obi.
Momodu talk dis oneĀ on Thursday while e dey react to political talk for Nigeria, say Atiku join ADC for November 2025 afta e comot from PDP so e fit secure party ticket for 2027 election.
According to am, Atiku plan am well as strategy to contest again, and no agreement dey between am and Peter Obi.
Last week for Nigeria, Peter Obi wey get over six million votes for 2023 election behind Atiku and President Bola Tinubu, also join ADC afta e leave Labour Party, as political movement dey heat up.