Sports

Dem chase me commot from Super Eagles because I no pass ball give Yekini – Siasia talk

todaySeptember 24, 2025 5

Background
share close

Former Super Eagles striker, Samson Siasia, don finally open up on wetin make dem chase am comot from the national team during him playing days. Siasia, wey be one of the top players wey help Nigeria win the 1994 Africa Cup of Nations, talk say dem drop am from the team just because he no pass ball give him teammate, the late Rashidi Yekini, during one important match. As he dey talk with Emmanuel Babayaro for UTVAfrica, Siasia reflect on the golden era of Super Eagles between 1990 and 1998. He explain say the issue happen during a 1994 World Cup qualifier against Ivory Coast for Stade Félix Houphouët-Boigny, Abidjan.

For the match, instead of Siasia to pass the ball to Yekini wey better positioned, he choose to shoot. National team coach that time, Clemens Westerhof, no happy with the decision and see am as selfish play, na so him come drop Siasia from the team. “I be striker. Rashidi Yekini no go give me that ball if na him dey that position, and that one na the truth,” Siasia talk. “Sometimes you go miss, sometimes you go score. Rashidi na one of the best strikers wey I ever play with. May him soul rest in peace.” He continue: “The first real down moment for me na when I no pass the ball give Rashidi Yekini and dem come kick me out of the team. I gats hustle my way back. Trying times dey always build you.” Siasia also defend himself say: “People talk plenty why I no pass the ball to Yekini. But even the one wey I pass give am, e no score. Things dey happen for football we no suppose carry am for mind.” Siasia’s revelation don shed light on the internal wahala wey dey happen for the golden generation of Super Eagles and how one decision fit change player career.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app