Super Eagles

56 Results / Page 1 of 7

Background

Sports

Eagles Coach Chelle scarra Say Young Boys to Enter Senior Team

By: Kofoworola Olayinka Super Eagles coachie Eric Chelle don go drop micro soft word dey shake everwia, jigijigi, say the young players wey play 3-3 draw with Russia get doings to play with di senior boys. U sabi say, Di coach use experimental squad wey get nine debutants, including three boys wey just be 19 years old play russia. Chelle explain say after how the boys take fight for Nizhny […]

todayOctober 9, 2026 9

Sports

Chelle Go Shake Super Eagles Line-Up For Guinea-Bissau Clash

By: Mariam Ajayi Super Eagles coach, Éric Chelle, dey set to shake up im starting eleven as Naija prepare to face Guinea-Bissau tonight for 2027 AFCON qualifier. Captain Wilfred Ndidi, Samuel Chukwueze and Al-Ittihad striker George Ilenikhena dey likely start from bench, as Raphael Onyedika, Frank Onyeka and Taiwo Awoniyi go take dia places. Chelle dey expected to keep di same four defenders wey start Friday 2-1 win over Madagascar, […]

todaySeptember 29, 2026 12

Sports

Iwobi Go Captain Super Eagles Against Guinea Bissau

By: Kofoworola Olayinka Fulham midfielder Alex Iwobi go captain Super Eagles tonight for dia 2027 AFCON qualifier against Guinea Bissau. Regular captain Wilfred Ndidi go start di match from bench, as Iwobi lead di midfield. Iwobi, wey don make 102 appearances for Nigeria, go hope say e fit help di team build on dia 2-1 win over Madagascar for dia first qualifier Iwobi go dey lead one reorganised midfield as […]

todaySeptember 29, 2026 10

Sports

Ilenikhena And Adams Wunjor Before Guinea-Bissau Showdown

By: Mariam Ajayi Super Eagles strikers George Ilenikhena and Akor Adams no train with di team for Uyo on Saturday as injury put dia Tuesday match against Guinea-Bissau in doubt. Di two players, wey start the 2-1 win against Madagascar on Friday wia Ilenikhena even score, na separate training dem do. Even though nobody know di full extent of di injuries wey dem pick up for the match, di team don […]

todaySeptember 28, 2026 11

Sports

Chelle Say Three Points Na Our Target Against Madagascar

Super Eagles coach, Eric Chelle, don assure Nigerians say hin boys ready to fight for di three points against Madagascar for dia 2027 AFCON qualifier for Uyo. Chelle give di assurance on Thursday during pre-match press conference as Nigeria dey prepare for Friday’s big game. He say di team don put the result of dia last World Cup qualifier behind dem and dem don focus fully on Madagascar. Chelle say […]

todaySeptember 25, 2026 13

Sports

Super Eagles Fans Believe Say Nigeria Go Beat Madagascar

As 2027 AFCON qualifier dey come, some Super Eagles fans don show confidence say Nigeria go beat Madagascar. Nigeria and Madagascar go play dia opening 2027 AFCON qualifier on Friday, September 25, for Godswill Akpabio International Stadium, Uyo, Akwa Ibom. According to reports, both teams train separately for Uyo on Tuesday as dem continue preparations for di match. And fans tell tori pipo for Lagos on Wednesday say Naija get […]

todaySeptember 24, 2026 17

Sports

20 Super Eagles Players Don Reach Camp For AFCON Qualifiers

Twenty Super Eagles players don reach camp for Ikot Ekpene ahead of dia 2027 AFCON qualifying matches against Madagascar and Guinea-Bissau. Di team open camp on Monday for Four Points by Sheraton Hotel, Ikot Ekpene, with coach Éric Chelle, im assistants and other backroom staff among di first people wey arrive. Captain Wilfred Ndidi, Samuel Chukwueze and goalkeeper Stanley Nwabali dey expected to join di team later today, while dem […]

todaySeptember 22, 2026 16

Sports

Awoniyi Don Return Super Eagles, Replace Osimhen For AFCON Qualifiers

By: Ayobami Dada Coventry City striker, Taiwo Awoniyi, don return to Super Eagles squad as e replace Victor Osimhen for di 2027 AFCON qualifiers against Madagascar and Guinea-Bissau. Di Nigeria Football Federation, NFF, announce Awoniyi call-up as di Super Eagles dey prepare for di important qualifying matches. Awoniyi wey don miss recent international games go give coach Eric Chelle another option for attack as e dey fight for place inside […]

todaySeptember 22, 2026 14

Sports

Chelle Drag Osimhen Wey Get Wunjury Enter Team List For 2027 AFCON Qualifiers

Super Eagles Oga Coach Éric Chelle don shock football fans as e drag injured Victor Osimhen join team list for 2027 AFCON qualifiers, now pipo dey wonderment wetin im e wan carry am do abi na hin mask e wan use take threaten opponent. Di Galatasaray goal-machine dey suffer waist-groin pain, lack of doing, but Chelle say make e still come face Madagascar for Uyo on September 25 and Guinea-Bissau […]

todaySeptember 18, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds