Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Denmark don yarn say dem wan ban social media for pikin dem wey no reach 15 years, as government talk say na to protect childhood and make young people mind better. Prime Minister Mette Frederiksen talk dis one for parliament on Tuesday, October 7, but she no talk which social media dem go ban or how dem go take do am. But di plan don cause plenty talk for Denmark and even outside.
Frederiksen talk say dem wan stop social media, but parents fit still allow pikin from 13 years old if dem set condition. She talk say phone and social media dey rob pikin dem childhood. She yan say many Danish boys aged 11 to 19 prefer to dey house than to waka meet friends because social media dey take over dia life. Denmark plan na part of big plan to help young people mental health and stop online wahala. Denmark dey join other countries like Australia and Greece wey don begin put rule for how pikin dem go fit use social media. Denmark government go still explain how dem go take do the ban later and e fit make other European countries follow.
Written by: News Editor 1
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025