Sports

D’Tigers Roast Cape Verde 100-84

todayAugust 31, 2026 4

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Nigeria basketball boys, D’Tigers, don wire Cape Verde 100-84 for Tunisia, as dem keep dia 2027 Qatar World Cup ticket dream alive.

Caleb Agada turn court to hin personal playground, scoring 26 points and dropping eight three-pointers like say net owe am money.

Coach David Fizdale boys start di game with serious fire, opening nine-zero lead and dey lead from first quarter till final whistle.

Cape Verde try come back, but D’Tigers no gree, as di gap reach 27 points before dem finally wrap up di match.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds