Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Naija’s D’Tigress don lose to South Korea 77-60 for dia second game for di qualifying tournament for di 2026 FIBA Women’s World Cup.
Di last time D’Tigress lose na for quarter-final against United States for di Paris 2024 Olympics.
Dem enter South Korea game on Thursday afta dem knack Colombia for dia first match for Wednesday.
For di first quarter, South Korea lead 20-16, and even though D’Tigress try improve for second quarter, South Korea still hold strong win di match.
Written by: News Author
D’Tigress FIBA World Cup qualifier Nigeria women basketball South Korea basketball
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026