By: Esther Ayoola
Shooting Stars Sports Club (3SC) for Ibadan beat Rivers United FC 2-1 for dia rescheduled NPFL Match Day 24 game wey hapun for Lekan Salami Stadium on Thursday.
Na dia 13th win dis season, wit 5 draws and 11 losses, now dem dey 6th position for di league table.
For home matches, 3SC dey strong, with 11 wins, 2 draws, and 1 loss, but dia away form nor too dey game, wit only 2 wins, 3 draws, and 10 losses.
Fans dey happy as dia team dey maintain beta home record and dey hope say dem fit improve for away games.