By: Esther Ayoola
Naija women basketball team, D’Tigress, don add one big game for dia USA tour as dem go play against Indiana Fever for preseason.
Di game go hapun for May 2, 2026, for Gainbridge Fieldhouse, Indianapolis, as dem dey prepare for 2026 FIBA Women’s Basketball World Cup.
Team Naija announce di new fixture for X, say dem don already get game for San Diego and Kansas City before dis one.