OBODO NAIJA

Edo Govment Condemn Attack On ADC Members

todayFebruary 26, 2026 3

Background
share close

Edo state Govo Monday Okpebholo of Edo State don condemned di recent attack wey happen to members of di African Democratic Congress (ADC), for tori wey busrt come out on Tuesday night, wey im describe as internal party gbege wey don enter another level.

Di govo wey sympathise with di affected members of di party talk say jaguda boys from ADC don carry dia gbege enter peaceful Edo state, say importation of jaguda boys from outside di state for party politics no dey acceptable going forward.

Meanwhile, social media burst as many people don remind okpebholo of di threat wey im give Peter Obi say e don come to pass.

Okpebholo insist say na internal gbege cause discasala say make police and security agencies shine dia eye wella wella to monitor political gatherings wey fit cause palava for di state.

Written by: Ridwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app