Sports

EPL Result: Man City, Chelsea Play Draw Open Way for Arsenal

todayJanuary 5, 2026 13 15

Background
share close

By Ebi Oboko

E be like Arsenal don dey peel out with the EPL title beating Bournemouth 3-2, and with plenty wahala result yesterday.

Leeds add salt to Ruben Amorim wunjury and Manchester United, drawing 1 1, Matheus Cunha ni score to save United one point.

Everton lose 2 4 to Brentford as Igor Thiago run hat trick, while Beto and Barry score for Everton.

Newcastle beat Crystal Palace 2 0 with Bruno Guimarães and Malick Thiaw goal, so like dis, dem dey push for top four.

Tottenham draw 1 1 with Sunderland, Ben Davies score for Spurs, Brian Brobbey reply for Sunderland; Fulham hold Liverpool 2 2 (Wilson and Reed score for Fulham; Wirtz and Gakpo score for Liverpool), while Man City draw 1 1 with Chelsea through Reijnders and Fernandez, so table still tight for top, middle, and relegation fight.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app