National

Ex-con Stab Police Officer Over Wife Wahala, Jail Matter

todayNovember 10, 2025 4

Background
share close

Pandemonium burst for Panseke area of Abeokuta, Ogun State capital, as one ex-convict stab one police officer for forehead early Friday morning. Di tori be say di ex-convict waka enter Panseke on top okada, come try collect AK-47 rifle from one police officer wey dey guard near armoured vehicle for di area. According to eyewitness, di man talk say him wan use di gun shoot another officer wey him accuse say dey knack him wife and na di same man cause di wahala wey land am for prison before.

 

When di ex-convict see say e no fit snatch di gun, e begin fight di police dem. As e no fit overpower dem, e pull knife from him trouser and stab di officer wey him claim dey sleep with him wife. Di noise make other policemen rush come, dem join hand tie di man hand and leg before dem carry am go. One source talk say di matter start as di ex-con reach di officers and begin struggle, but end as dem subdue am. When dem reach out to Ogun State Police PRO, CSP Omolola Odutola, she yarn say she never hear about di incident.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app