Sports

Falconets Chop 2-0 First Breakfast For World Cup

todaySeptember 8, 2026 2

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Falconets don chop first breakfast for FIFA U-20 Women’s World Cup as defending champions Spain show dem pepper 2-0 inside Poland on Monday.

Di Spanish girls hold ball like say dem own am, come open score line for 13th minute through Marisa Garcia to put Nigeria for tight corner for ArcelorMittal Park.

Coach Moses Aduku girls try dia best to equalize di score, but Spain solid defense turn to iron gate wey di Nigerian strikers no fit break through.

With dis loss, Falconets go need to tighten dia belt and reorganize dia strategy if dem wan escape Group F and keep dia World Cup dream alive.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds