OBODO NAIJA

Federal High Court Go Dey Open Weekend For Election Case Filing

todayMay 28, 2026 4

Background
share close

By: Esther Ayoola

Federal High Court of Naija don order say all dia registries for every division across di kontri go dey open weekends and public holidays from 10am reach 2pm to collect only pre-election matter papers ahead of 2027 general elections.

Chief Registrar of di court, Yahaya Shafa, yarn dis one for statement wey dem release on Thursday, say dem do am because di time wey law give for filing and judging pre-election cases no too plenty.

According to am, di move go help lawyers and political parties meet deadline without delay as election preparations dey start.

Di directive go work for all Federal High Court branches for Naija until further notice.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds