Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di Federal Gornment don beg local airline operators make dem no stop flight operations because of di sharp increase for Jet A1 fuel price.
Minister of Aviation, Festus Keyamo, make dis appeal for one letter wey im send give Airline Operators of Naija on Thursday.
For di letter, Im also beg dem make dem think again before dem increase flight ticket price for passengers.
Dis mata come as many airlines threaten say dem go suspend dia operations next week if nothing change, because di cost of aviation fuel don too high.
Keyamo tuk say gornment don already arrange emergency meeting with all di stakeholders to find better solution to di problem.
Written by: News Author
airline operators nigeria aviation fuel price rise fg aviation meeting fuel cost increase aviation
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026