By: Esther Ayoola
Federal Gonment don reject claim wey Air Peace Chairman and CEO, Allen Onyema, make say new tax regime go cripple aviation industry and make air ticket cost jump.
You sabi say, Onyema tuk for TV sitdon tuk Sunday di dangers wey go follow di new tax law for wi aviation.
Chairman of Presidential Committee on Fiscal Policy and Tax Reforms, Taiwo Oyedele, respond on Monday say Onyema tuk misleading and no reflect wetin di reforms really be.
Oyedele yarn dis one for statement wey he post for him X handle, less than 24 hours afta.