Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
The Federal Government don describe di take-off of Nigeria first-ever methanol and ammonium bicarbonate factory for Ondo State as massive industrial investment wey get plenty potential to boost di country economy. Minister of State for Petroleum (Gas), Ekperikpe Ekpo yarn say di Chinese factory go increase local production of chemicals and fertilisers. Ekpo wey dey tour di site for Ondo-Linyi Industrial Hub, Omotosho, Okitipupa Local Council, yarn say di factory go produce 100,000 metric tonnes of methanol and 160,000 metric tonnes of ammonium bicarbonate yearly, wey be historic for Nigeria. Di minister yarn say President go happy with wetin dey happen here, as people dey use our natural gas resources develop di nation economy.
Chairman of di Chinese investors, Supertech Chemical Industry, Yang Jijiang yarn say dem dey proud to support Ondo industrialisation and Nigeria economic growth. Alexander Ajipe, Principal Consultant to Ondo-Linyi hub, yarn say di minister tour boosted di morale of Chinese investors. Governor Lucky Aiyedatiwa hail di minister visit and praise ONDIPA for removing bureaucratic wahala wey dey stop investors.
Written by: News Editor 2
Nigeria methanol plant Ondo industrial projects
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025