Sports

Flamingos Scatter Nazareth Queens 7-0 for World Cup Warm-Up Match 

todayApril 28, 2026 4

Background
share close

Flamingos wey be Nigeria U-17 women team don mash Nazareth Queens 7-0 for their World Cup qualifier prep match for Abuja.

Dem carry 2-0 go enter halftime as Wuraola Olayiwola score for 8th minute and Oluebube add another one for 34th minute.

Na so For second half, Harmony Chidi shine with two goals for 48th and 54th minute, while Oluwakemi Adegbuyi score penalty for 59th minute to make am 5-0.

Dem later complete di beating with two more goals to seal correct 7-0 victory and show say dem ready for qualifiers.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds