obodo oyinbo

Flights For Major US Airports Delay As Control Cable Cut.

todaySeptember 22, 2026 1

Background
share close

By: Ayobami Dada

US aviation official Bryan Bedford talk say flights delay for major US airports on Monday after construction workers cut cable wey air traffic controllers need to guide planes during take-off and landing for New Jersey.

US Transportation Secretary Sean Duffy say di workers dey work for Amtrak when dem cut di cable, causing ground stops for airports across New Jersey.

Duffy say flights don start again for New York LaGuardia and Philadelphia on Monday, but plenty flights still dey delay as workers dey fix di problem.

Di kasala bust just a day before United Nations General Assembly,(UNGA) go start for New York on Tuesday, as many people dey travel enter di city.

Written by: News Editor 2

Rate it

Similar posts

obodo oyinbo

Trump Threatens Iran Say Economy Fit Destroy

By: Mariam Ajayi US Presido Donald Trump don warn Iran say if dem no reach agreement with America, e fit  wipe Iran out or make dia economy rot. Trump give di warning during Fox News interview on Sunday, as tension dey rise ahead of United Nations General Assembly for New […]

todaySeptember 21, 2026 7


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds