Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di open ocean normally dey flow with fresh breeze, but one cruise ship bring one ogbonge sickness, wey spread body like egg for aboki meshai bread, don leave pipo dey wonderment.
Dis time around nor be corona virus, dem call dis sickness Hantavirus. Dis virus pick race dey spread like say im dey run Olympic race with cheetah, just di same way one bad apple fit spoil full basket of tomatoes before you blink eye, na so e hapun for south America.
Based on say na water movement dis sickness take start, dem suppose call am mami water sickness, but di koko be say, e nor really start for inside water but na for land di thing take hook di travellers, just like how hidden passenger fit hide inside car boot without di driver knowing until di motor don reach long journey.
Dis disease first show face for Korean War inside di 1950s when plenty soldiers begin get heavy fever and kidney failure, before scientists later trace di cause say na bush rat dey cause am, dat di rat dey spread di virus through dia urine and kahkah.
According to tatafo pipo, di recent jogolo be say, na one Dutch man carry dis sickness enter di cruise boat on April 6, 2026.
Fever dey catch am, im nor treat am, im carry dey go enjoy imsef. And you know say sea breeze dey blow wetin nor good, na so e take blow di sickness come out, put everybody wey dey with am for red line.
As di mata tak baje reach, World Health Organization (WHO) carry eye enter di case and con report say dis man successfully don donate dis sickness to 12 pipo and don 3 kpai inside, mean say, play play don turn to eat and go.

To quench dis fire, international body mata pipo sharp-sharp package means to stop di spread, which is, all di pipo wey catch di sickness, dem lock dem for room, with massive contact tracing across 30 countries, and total quarantine for passengers, acting exactly like fence wey wire dey surface to stop stubborn goats make dem no scatter farm.
Di koko right about now, be say, di number one international body mata pipo don clear everybody inside di ship, dat means, my brodas and sistas we gat be careful as health groups dey tell pipo to shine eyes because our world today be like big spiderweb wia touch for one corner dey shake di whole net.
Since di sickness still dey catch pipo till today, experts dey warn everybody say di only way to guide yourself na to clear rats from your house, keep environment clean, and run enter hospital sharpaly, if any pesin begin sick for your house.
– Jolayemi Olajide
Written by: Rilwan Agbomeji
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026
This will close in 0 seconds