By: Esther Ayoola
Naija political senior mehn don drop bumbshell, say na because say Naija youths dey comot bodi from politics na make di kontri dey shake, calling old politicians to give young pipo chance, particularly as dia brain sti sharp
Dem tuk dis one for memorial lecture and leadership conference wey Murtala Muhammed Foundation organise to mark 50 years since dem kpai di former Head of State Murtala Muhammed.
Leading di tuks, Former Presido Goodluck Jonathan, say African countries suppose focus on pipo wey dey between 25 and 50 years, and make dem reduce age limit for politics, arrange ogbonge law called Naija “Not Too Young to Run” law.