By: Esther Ayoola
Former Venezuela presido, Nicolas Maduro and im wife Cilia Flores don tuk for di first time for U.S prison say dem dey strong, calm, and dey pray inside Brooklyn prison.
For a message wey dem share for Maduro’s X account, dem thank supporters for prayers and dia support.
News source close to Venezuelan gornment say, Maduro dey read Bible every day, and im fellow prisoners sti dey call am “presido,”.
Maduro sha explain dat im na “prisoner of war,” and im message show say im dey hand im new life with sense and spiritual support.