Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di tori of how 39-year-old Professor Segun Aina take become di new Registrar of di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) normally suppose to be beta ginger for everyone.
Na Thursday, May 21st, 2026 wey news break say na new senior man, Prof Aina, go take over for JAMB after Professor Ishaq Oloyede tenure finish on July 31st, 2026, expectation dey very high, nor be lie for reason being dat Prof Aina di first youth in history to double as master. Dis history wey im make as di youngest person to ever head di board don make many book-pipo across Nigeria dey jubilate. “Normally, to be youth na fine thing, but when youth merge with computer sense and beta character, nothing fit stop am to build wetin eye never see”, Dis deep word na perfect mirror for Professor Aina life and how he take clear road climb up.

Di guy no just get di job because him dey young; according to report him land dis dream position sake of say im na wizard for technology matter.
Aina go clock 40 years for July, im do Bachelor degree in Computer Systems Engineering for di University of Kent, before he do both Master’s in Internet computing and network security, and PhD for inside Digital Signal Processing for Loughborough University for UK, Di sweet part of di tori be say, Prof Aina and JAMB no be today dem know demselves.
Long before Baba Seyi appointment, GCFR, call am come collect di key of di agency, im bin don first enter di place with green-khaki as ordinary National Youth Service Corps (NYSC) corper.
Na inside that service year im first master how dem dey run student admission and handle national data, and dis one show say life na turn-by-turn and small start fit lead to big destination.
If you look him academic level, Aina na original heavy-weight. At just 39 years old, he don already drop anchor as Professor of Computer Engineering for Obafemi Awolowo University (OAU), Ile-Ife, wey be one of di youngest for di country.

According to report, Aina nor be di kind of professor wey just dey write theory for blackboard; na di type wey dey carry computer code solve real life problem, and na why him name dey ring bell for tech ecosystem. Aina waka nor just end for classroom inside Ife, he don waka go outside, For di pass 15 years, he don dey run consultant jobs for top-level gornment places, like di Job Creation Unit inside Vice Presido office and different state governors, Im don even work with other heavy exam bodies like NECO and NABTEB to design digital network wey to block exam expo, so di area of exam security no be new thing to am at all.
However, di koko be say, with all im experience im sti get a big shoe to fill. As he dey arrange body for di JAMB chair from August 2026, heavy work dey wait for am because Professor Oloyede set di standard high. People go want make he maintain di transparency and still use im tech background raise di bar. But with di solid computer foundation im get plus di Senior Management certificate wey im collect for Lagos Business School, he get di full engine to carry di load.
To wrap di tori up, Professor Segun Aina appointment na big signal to all Nigerian youth say hardwork and book still dey pay. His story clear doubt say when person focus and opportunity hit am, age no be barrier but na advantage to bring new innovation. As di tech expert dey waka to control di table where he once for serve as corper, everybody eyes dey look to see di new digital levels wey JAMB go face.
-Ebi Oboko
Written by: Rilwan Agbomeji
todaySeptember 9, 2025 52 7
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026
This will close in 0 seconds