By: Esther Ayoola
Federal Road Safety Corps (FRSC) for Ogun don send advise to drivers to reduce speed and dey careful when dem dey approach potholes for highway to avoid askident during rainy season.
Ogun Sector Commander, Oludare Ogunjobi, naim dey tuk am on Monday for Ota while e dey speak with tori pipo.
E explain say wet road dey slippery and speed fit make driver lose control easily, especially during rain period.
E also urge motorists make dem keep double or triple distance between vehicles so dat dem fit get enough time to brake and prevent askident.