By: Esther Ayoola
Untop reactions, Rivers State Govo, Siminalayi Fubara, don clear im pipo say im ma nor dey worry bodi, dey tell dem not to panic even say political wahala carry beta trailer put for dia neck.
Dis na di first time wey di govo dey appear publicly since lawmakers start di fresh impeachment plan.
E yarn dis one on Sunday inside church service to mark 2026 Armed Forces Remembrance Day for St Cyprian’s Anglican Church, Port Harcourt, rivarians nor get any fear, say im get God for im side.