rivers state politics

12 Results / Page 1 of 2

Background

OBODO NAIJA

Wike Say Fubara Miss Second Term Chance Over Rivers Crisis

By: Esther Daniel FCT Minister Nyesom Wike talk on Tuesday say di political crisis for Rivers State don cost Gornor Siminalayi Fubara im chance to contest for second term. Wike yarn during im monthly media chat say wrong advice from political allies and outside interests make Fubara abandon di political structure wey bring am to power. Di former Rivers governor reveal say e warn Fubara several times make e no […]

todayAugust 4, 2026 12

National

Fubara Declare Support for Rainbow Coalition, Tinubu

By: Esther Daniel Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, don declare support for Rainbow Coalition, di political group wey FCT Minister Nyesom Wike dey lead for Rivers State. Fubara tok dis one during di groundbreaking ceremony for Riven Medical Facility, where e also confirm President Bola Tinubu as im preferred presidential candidate and Kingsley China as im choice for governor for 2027 election. Di governor tell all im supporters make dem […]

todayJuly 22, 2026 11

OBODO NAIJA

Wike Burst Bubble Say Amaechi Make Mistake Join ADC Presidential Race

By : Jolayemi Olajide FCT Minister Nyesom Wike don drop micro soft word say, former Rivers State Govo, Rotimi Amaechi, dey big boy, oganaogan, con make serious mistake by contesting for 2027 presidential ticket under ADC platform. Di senior man yarn dis one for  im monthly media chat for Abuja on Monday Wike  say if to say  Amaechi  ask,  im for advice am  before joining di race, e for tell […]

todayJune 1, 2026 14 1

National

Wike Burst Bubble Say Na Rainbow Colour Collabo Go Produce River 2027 Govo

By: Esther Ayoola Di Minister of Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike, don blow fuse say di four political parties inside di "Rainbow Coalition" for Rivers State never pick anybody for di 2027 governorship election. Wike bin tuk dis one on Saturday during one lunch date wey dem set up for all di coalition candidates inside Port Harcourt. Im clear di doubt say make nobody dey look up to any […]

todayJune 1, 2026 16

OBODO NAIJA

George-Kelly Comot From Rivers All Progressives Congress Governorship Primary Race

By : Jolayemi Olajide Rivers State Governorship Aspirant for di All Progressives Congress (APC), Alabo George-Kelly, don comot body just few hours after Siminalayi Fubara announce say im no dey  join  body again inside di APC governorship primary race. For statement wey George-Kelly release on Wednesday, say e take di decision after one big meeting with APC leaders. George-Kelly talk say na loyalty, respect and leadership dey guide am for […]

todayMay 21, 2026 13

Politics

Governor Fubara Pull Out From APC Guber Primary Election

Di Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, don announce say im no dey join body again inside di All Progressives Congress (APC) governorship primary election for di state. Inside one statement wey im sign on Wednesday, Fubara tuk say e take di heavy decision after e do tight consultation with im family, friends, and political partners. Im sha promise to support anybody wey di party choose as dia flagbearer for di […]

todayMay 21, 2026 23

National

Rivers Political Crisis Hit Anoda Level As APC Fail To Konfam Fubara Screening For 2nd Term

By: Esther Ayoola Say confusion Gadima, why All Progressives Congress nor gree konfam di screening for suspended Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, afta im show face for dia ongoing screening of governorship aspirants. In fact, as di mata take hot reach, Party National Secretary, Ajibola Basiru, clear journalists on Sunday wetin really play but dodge all di question on whether dem screen di governor. E neither konfam nor deny if […]

todayMay 11, 2026 13

National

Rivers Lawmakers Accuse Fubara, Insist Say Dem Must Impeach

By: Esther Ayoola Lawmakers of di Rivers State House of Assembly today we be Friday, dey insist dat, dem must investigate dia govo, Siminalayi Fubara, even accuse am say, im dey blackmail dem. Di lawmakers hold press today for Port Harcourt, wia dem tuk dia mind say Fubara nor dey fit enough to handle crisis for di oil rich state. According to di lawmakers, Fubara dey infringe on di 1999 […]

todayJanuary 16, 2026 19

National

Fayose Tell Fubara Make E Climb Down From High Horse

By: Esther Ayoola Former Ekiti State Governor, Ayo Fayose, on Tuesday advise Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, make e reconcile with Minister of FCT, Nyesom Wike, instead of dey engage in political confrontation. Fayose make dis statement during interview with media tuk tuk for Lagos. E explain say all di governors, including Fubara, get dia strength from other people, so humility dey important for leadership. Di former governor add say […]

todayJanuary 13, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds