obodo oyinbo

Gas Explosion Wipe Out 34 Coal Miners For Pakistan

todayJuly 31, 2026 4

Background
share close

By: Esther Daniel

Methane gas explosion don kill 34 coal miners inside one coal mine for Balochistan, Pakistan, after di blast scatter di underground pit on Thursday night.

Disaster officials confirm di death toll for Quetta on Friday, say di powerful explosion trap di miners underground before rescue teams reach di scene.

Joint rescue teams later recover all 34 bodies as emergency workers use heavy equipment take clear di deep mine.

Authorities don begin investigation to find out wetin cause di explosion and how to stop another tragedy like dis.

 

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds