By: Esther Ayoola
Electricity generation companies, Gencos like dis now don dey beg Nigerian Electricity Regulatory Commission, NERC, make dem quickly adjust electricity tariff afta Federal Gornment raise domestic gas price.
CEO of Association of Power Generation Companies, Joy Ogaji, say delay in tariff review don dey worry dia body already and she yan dis one during interview on Monday.
She explain say gas don cost, so any extra wey dem pay go reflect for consumers bill.
Ogaji sti yan say, di wahala for di power sector, na say pipo nor dey pay bill as dem suppose to, no be high price.