International

Ghana Police Free 57 Nigerians From Cybercrime, Trafficking For Accra

todayOctober 24, 2025 4

Background
share close

Police for Ghana don rescue 57 Nigerians wey dem traffick enter di country come force dem do cybercrime waka. Authorities confirm di mata on Thursday, October 23. Di victims, all between 18 and 26 years, bin dey trapped inside one house for Accra suburb before police raid am on Wednesday. According to di Criminal Investigations Department (CID), di Nigerians bin dey run online romance scam after traffickers deceive dem with fake job offer. Police collect 77 laptops, 38 phones, two motors, three TV and other gadgets wey dem take do di bad business. Five suspects don land for cell as CID talk say di rescued people dey receive care and support, but dem never talk when dem go send dem back go Naija.

Di incident don raise new wahala about di rate of human trafficking and cybercrime network wey dey spread for West Africa. Ghana Ministry of Gender talk say between 2023 and 2024, dem don prosecute 79 cases and convict 54 people for human trafficking mata. Dis latest rescue join di big crackdown wey dey happen for Africa. Last month, Interpol arrest 260 suspects for 14 African countries over online scam wey chop almost $2.8 million. Ghana self no left behind dem nab 68 suspects wey dey use fake identity scam people and record dem for blackmail.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app