south west

Governor Makinde Beg Government As NLC, NUT, And NANS Protest Over Oyo School Kidnap

todayJune 3, 2026 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Oyo State govo, Seyi Makinde, don call on all levels of gornment make dem join hand together fight security wahala and rescue di students and teachers wey bad boys kidnap for Yawota and Ahoro Esinele communities inside Oriire Local Government.

Governor Makinde tuk dis one on Tuesday when im receive leaders and members of NLC, NUT, and NANS wey do peaceful protest for di state  Secretariat.

Di govo describe di  kidnap mata as national wahala, and im warn pipo to stop  playing  politics with di situation.

Governor Makinde konfam say im truly meet with di NANS, NUT, and NLC leaders as dem carry dia protest come di Oyo State Secretariat for Agodi, Ibadan.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds