Lagos

Governor Sanwo Olu Cancel Lagos Greater Fiesta

todayDecember 31, 2025 6

Background
share close

By: Esther Ayoola

Area spoil say Lagos State Government don cancel di 2025 Greater Lagos Fiesta wey suppose hold today, December 31, 2025.

Governor Babajide Sanwo-Olu, through im media aide Gboyega Akosile, ask make instead of di fiesta, Lagos people spend di time for personal prayers for Nigeria, Lagos State and everybody wey dey live for di state.

Di governor urge residents make dem pray for peace, good leadership, prosperity, productivity and general wellbeing.

Im wish all Lagosians happy and better 2026, say im government go work harder to bring better life for di people and encourage peace and unity.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app