Sports

Guardiola Put Backing For Nico O’reilly To Win Young Player Award

todayApril 20, 2026 4

Background
share close

By: Esther Ayoola

Manchester City coach Pep Guardiola don praise young midfielder Nico O’Reilly for im strong performances so far and say e deserve Premier League Young Player of di Season award.

Guardiola tuk dis one afta Man City beat Arsenal 2-1 on Saturday, as e highlight how O’Reilly assist Erling Haaland for second half goal wey hellep dem win di match.

According to post wey journalist Fabrizio Romano share for X on Monday, Guardiola say nobody reach O’Reilly for di young player award dis season.

E add say di boy consistency and impact for pitch na why e suppose win am.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app