obodo oyinbo

Guinea Coup Leader Doumbouya Win Presidency With Big Landslide

todayDecember 31, 2025 3

Background
share close

By: Esther Ayoola

Guinea election authority don declare Mamady Doumbouya, di coup leader wey take power for 2021, as winner of di guinea 2025 presidential election.

Dem announce di provisional result on Tuesday, say di vote wey happen December 28 give am 86.72 percent, wey make am win straight without runoff.

Dis election na di first one for di country since di military takeover, and many observers say e happen to legitimize Doumbouya as di ogbonge leader of di west African kontri.

According to report, Di Supreme Court for Guinea go sti review di result within eight days, in case anybody challenge how di election take run.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app