By: Esther Ayoola
Guinea election authority don declare Mamady Doumbouya, di coup leader wey take power for 2021, as winner of di guinea 2025 presidential election.
Dem announce di provisional result on Tuesday, say di vote wey happen December 28 give am 86.72 percent, wey make am win straight without runoff.
Dis election na di first one for di country since di military takeover, and many observers say e happen to legitimize Doumbouya as di ogbonge leader of di west African kontri.
According to report, Di Supreme Court for Guinea go sti review di result within eight days, in case anybody challenge how di election take run.