House of Representatives committee chairmo, Yusuf Gagdi, don tok say investigation don show say di appointment letter wey Director-General Adeyemi present na fake, and even di law wey e use support am na forged document.
Gagdi tuk dis for Abuja on Wednesday, as Head of Civil Service of di Federation, Didi Esther Walson-Jack, appear before di committee for di second time and confirm say di documents no be original.
Walson-Jack admit say her office no do enough verification before dem recognise di so-called Presidential Foreign Intervention Promotion Council.
She accept responsibility for di mistake and promise say proper checks go dey to stop this kind thing from happening again.
Read more tori for here:https://konfamfm.com/news-house-of-representatives-scata-as-lawmakers-clash-to-summon-president-tinubu/