Sports

Hearn Konfamate Say Joshua And Fury Go Fight

todayAugust 25, 2026 4

Background
share close

Boxing promoter Eddie Hearn don talk say announcement for di long-awaited Anthony Joshua versus Tyson Fury fight fit happen soon as negotiations enter “crunch week.”

Both fighters don sign contracts to fight each other but Joshua deal reportedly say di fight suppose happen for United Kingdom.

Organisers including Netflix and Saudi financier Turki Alalshikh dey push for di fight to hold for America, especially Madison Square Garden for New York, while Hearn accuse dem of trying to go against Joshua agreement.

Hearn don send contract changes wey fit allow di fight happen for America and he dey wait for response, even though say di America waka nor sweet dem for belle.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds