By : Jolayemi Olajide
Chai, heavy problem for southern Philippines on Monday, dat one massive 7.8-magnitude earthquake shake the area.
Dis na according to di United States Geological Survey, and USGS, wey konfam di mata, and at least 15 pipo don kpai near General Santos City.
According to Philippine authorities, the earthquake hapun inside water for the southern part of the city.
Based on dis, Philippine gornment don order make pipo wey dey live near the beach, run go higher ground because tsunami.