By: Esther Ayoola
UK Court, Woolwich Crown don go convict 4 out of 6 pro-Palestine activists for criminal damage wey dem do during 2024 raid for Israeli defence company Elbit factory for Bristol.
Prosecutors tuk say di four persons na members of Palestine Action group wey authorities ban, and na dem go organise di attack for di facility.
Court also tuk say one of di accused dey guilty for hitting police officer with sledgehammer, and di whole damage wey im do go reach about £1 million.
Two other defendants, Zoe Rogers and Jordan Devlin, naim escape say dem nor dey guilty.