By: Esther Ayoola
Say nor be small fear catch fans on Sunday as Denmark midfielder, Christian Eriksen, fall down for pitch during dia friendly match against Ukraine.
Dis badness dey hapun for di second time to di 34-year-old player afta im heart first stop during di Euro match against Finland five years ago.
Di Danish Football Association don bring statement say Eriksen eye dey open and im dey receive treatment for hospital.
Di team doctor, Morten Boesen, yarn say di player even waka comot di pitch by himself because di special machine (pacemaker) wey dem wire to im enter im heart work.