Sports

Cristiano Ronaldo Retire From International Football

todayNovember 5, 2026 5

Background
share close

Portugal football legend, Cristiano Ronaldo, don announce say e don retire from international football.

Di 41-year-old Ronaldo, wey dey play club football for Al Nassr, score 146 goals and make 234 appearances for Portugal since e first play for di country in 2003.

Ronaldo announce him retirement weeks after e comot from Portugal national team camp last month, following report say dem no go put am for di starting line-up for Nations League match against Denmark.

For October, Ronaldo reportedly get disagreement with Portugal coach, Jorge Jesus, after di coach no gree start am for one Nations League match.

Ronaldo sharpaly comot from di team camp and dem later give am 30-day suspension.

Although rumours dey say e plan to return to di national team, di five-time Ballon d’Or winner release one video for im X account on Thursday, where e announce say e don end im international football career.

During im time with Portugal, Ronaldo hellep di country win European Championship for France in 2016, although injury force am to leave di pitch during di final match.

For di 2026 World Cup wey dem host for United States, Canada and Mexico, Ronaldo score three goals, but Portugal no fit pass Round of 16 after Spain knock dem out. Spain later go on to win di trophy.

Ronaldo retirement from international football come after im longtime rival, Lionel Messi, also play im final match for Argentina last month.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds