By: Esther Ayoola
Drama burst for National Assembly of Naija on Tuesday as lawmakers approve electronic transmission of election results but sti keep manual collation as backup ahead of 2027 elections.
A move wey bring serious argument for both Senate and House of rep.
For Senate, about 15 lawmakers led by Enyinnaya Abaribe protest against di clause wey say manual Form EC8A fit serve as main result, if electronic transmission fail.
Na so dem march out, accusing di ruling parti all progressives congress say, dem be Oleh
For House of Representatives, minority lawmakers waka comot accuse Speaker, Tajudeen Abbas leadership, say, why dem dey rush di amendment without allowing full electronic transmission without condition.