Say nor be small thin sup on Friday for Asa Awara Road near Ochia Autonomous Community, Imo State, dat unknown gunmen go kpai Eze Paulinus Ekwueme, di traditional ruler, im two brothers, driver and security aides as dem dey return from meeting.
According to report, Di attackers open fire, kill dem, then burn dia bodies and di monarch official vehicle for road.
Police tuk tuk, Okoye Henry naim explain dis mata to tori pipo on Monday, say, Imo State Police Command receive distress alert and before dem reach dia, mouth nor fit explain wetin dem see
Imo State Commissioner of Police, Audu Garba Bosso, sef don condem di attack and assure say security operatives go fish out di perpetrators.