Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Lagos State College of Health Technology, LASCOHET, don hala warning to people after one cyber café operator knack admission seeker N500,000 scam say e go help am get admission for the school. According to petition wey dem give Provost of LASCOHET, Prof. Raheem Akewushola, the person wey want enter study Health Assistant talk say the suspect ask for N1.5 million to do the work. She pay N500,000 as part agreement but dem no give her admission and dem no return her money. The applicant talk say when the admission wey dem promise no show, the suspect still tell her say she go later get certificate even if she no attend class. She vex because the koko no make sense, so she ask for her money back. But the suspect begin threaten her make she keep quiet. For statement wey Prof. Akewushola issue on Sunday night, e condemn the scam and talk say when LASCOHET management question the suspect, the suspect admit the matter.
The suspect later try explain say the money no be for LASCOHET but for one professional body wey e no talk the full name, only say na “CIMB,” and say e be liaison officer for the place. But e no fit talk wetin the acronym mean. “Stamp pads wey come from different different institutions dem still recover am from im shop, and dem still dey do more investigations now now,” na wetin the provost talk. Akewushola talk say di suspect no be worker and e no even be agent of LASCOHET, and e warn people make dem no do any business with am. “Anybody wey choose say e wan do business with am, na im own risk be that,” e warn.
Written by: News Editor 1
ADMISSION FRAUD FINANCIAL FRAUD SCAM AWARENESS
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025