Entertainment

“I Fit Fail As Musician, But Not As Papa” – Adekunle Gold

todayOctober 10, 2025 95

Background
share close

Nigerian singer, Adekunle Gold, don pour him heart out as he reveal say na him wife, Simi, and dia daughter, Adejare, dey run things for him life now. Di music star yarn dis one for NotJustOk podcast, where he talk say him number one mission na to give Adejare soft life wey go beta pass wetin him hustle through as pikin. According to am, he no dey ever reason make him daughter enter that kind kind ghetto life wey him grow for, say e must clear road for her with better love and comfort.

As he open up about wetin ginger him to write ‘My Love Is The Same’, AG Baby no hold back. He talk say di song na from deep commitment to be a solid, present papa wey no go carry last. In him raw words, “All I wanted is to do more for my own daughter because I can’t afford to bring her into di kind of life I grew up living. It has to be way better. My family is my centre. I can afford to be a failed musician, not a failed father or man. That’s not negotiable.” Na man wey know wetin matter be dis.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Mohbad Family Sti Dey Fight for DNA of Hin Pikin

Di family of late Nigerian singer, Ilerioluwa Aloba, wey everybody know as Mohbad, don demand make dem reveal di name of di US laboratory wey dem wan send di sample go for di DNA test to clear who be di real papa of hin pikin, Liam. Mohbad family still call […]

todayOctober 30, 2026 12


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds